De Obong of Calabar wey be His Eminence Edidem Ekpo Okon Abasi Otu V Treaty King, Natural Ruler, Grand Patriarch of the Efiks and Defender of the Faith yesterday bin tell him friend wey come visit am from Benin, de Oba of Benin His Royal Majesty, Omo N'Oba N'Edo, Uku Akpolokpolo, Ewuare II, sey him go enjoy Calabar well well, and sey till him die him no go forget Calabar becos of de way wey dem go treat am.

Na so de Obong come tuk sey make de Oba relax enjoy himself, afteroll him great, great great grand father bin live and die for Calabar so Calabar na him second home.

Some Eso state pipo wey don live for Calabar tey tey, come follow chuck mouth take greet de Oba to tellam sey Oba Welicome. For their greetings, na Sao dem come beg Oba sey make him follow chuck mouth beg Oga governor to give them land to build their office and also make them for take put up some tin to take remember their Oba wey bin live and die for Calabar.

For him own tuk wey come be like sey na response, Etubom Emmanuel Nsan, former Minister of Health come tuk sey him happy well well for that statement sey them wan put structure to take remember their forefather wey Iive and die for Calabar. Him tuk sey even though him agree with that statement, but na Etubom Traditional Council go decide on de matter Las Las.

As e bi, na so dis Oba visit don take Waka for plenty pipo mouth, setey dem don tuk plenty plenty tuk about de matta, even de one wey correct o and de wan wey no correct piop don tuk all for Facebook, Twitter, Instagram and even for inside market and church dem all.

One tin be sey, de visit too make sense as e don cement de relationship and brother matta wey Efik and Benin pipo bin get since 300 years ago wey one
Oba of Benin wey dem call Ovọnramwẹn Nọgbaisi bin run make Onyibo no kill am as dem bin wan take him land.

Na so de Oba run come Calabar with him two of his wives, Queen Egbe and Queen Aighobahi. Na Etinyin Essien Etim Offiong, bin carri am put for house for Essien Town. De Oba bin come die for 1914, so dem bury am for Calabar.