As we bin don report last time sey, de Oba of Benin bin come visit him friend Obong of Calabar for him Palace for Calabar. Naso pipo come de ask, de tok sey wetin bring dis two gum bodi like dis?


Well make una remember sey, de two two both of dem bi wetin dem de call "First Class Kings" dem come also be "Natural Rulers" wey mean sey, their kingdom bin don dey since before white man come Africa. Even as white man in wan come go back, na dem go England go sign that document wey dem dey call "Treaty". For de whole of Nigeria na only 6 of dem dey as "Treaty Kings" and Natural Rulers.


So, apart from dis status relationship wey dem share, de Bini Pipo and Efik come also share one special history like dat, wey concern their Oba.
History tok am sey for 1897, Onyibo out of longer throat to control market and all de good good tins for Bini bin come drive Oba Ovonramwen wey bin be de Oba of Benin dat time, na so dem pursue am, him come run come stay for  Calabar. De Calabar pipo receive am, accept am, him live with dem for Calabar and dem treat am well as king till him come die for 1914 and dem bury am here for Calabar.

So de coming wey Oba Ewuare II, come take visit de Obong of Calabar so, na dey second time wey de Oba of Benin de come Calabar bi dis, and dis time him Waka well. Him come as person de come visit him friend and mate. Make una remember sey for de whole of Nija, na only 6 of dem dey. And for your infomate, dem bi:
1. Obong of Calabar
2. Ooni of Ile-Ife
3. Oba of Benin
4. Sultan of Sokoto
5. Obi of Onitsha
6. Emir of Kano

So therefore, anybodi wey think sey him fit or wan carri himself compare with de Obong of Calabar, make him think am again, because for de whole of Cross River State nobodi get dat swag reach de Obong of Calabar.

Dis visit wey Oba come visit Obong of Calabar, na wetin de two kingdom no go forget for hurri hurri becos plans don de ground as a result of dis visit to build research center wey go cost plenty plenty millions and dem go also build wetin dem call Benin House.




Originally written in English by
Efio-Ita Nyok | 13 January 2020 you can also read the English version here:
Historical Significance of the Visit of the Oba of Benin to the Obong of Calabar