Oba as him de come down from plane.
Photo credit: George Odok 

The oga kpatakpata of de Benin Kingdom wey dem de call Oba of Benin don show for Calabar to come visit him fellow Calabar country man for de Efik Kingdom, wey be de Obong of Calabar.

According by our tori person wey bin dey for Margeret Ekpo International Airport for Calabar, de Oba waka for him private jet come land ground for exactly 6:53 for evening on Friday.

Make we remember sey we bin don yarn una sey de Oba wan come see him fellow ruler wey be Obong of Calabar to tell am sey, thank you for sey you bin get time come my coronation.

We come gada sey de Oba go also meet with him Benin people wey de live for Cross River State and Akwa Ibom State. Him go get small tuk with dem. Den him go come meet with oga governor of de Cross River State by Monday before him come jet out again.

Also we gada sey de Obong de plan to host him guest for Royal banquet for Adiabo on Sunday while dem go make sure sey small chop chop and gbedu go hold for Obong Palace on Saturday