His Royal Majesty, Omo N'Oba N'Edo, Uku Akpolokpolo, Ewuare II, Oba of Benin



According to de tori wey come for our tuk tuk table, His Eminence, Edidem Ekpo Okon Abasi Otu V, Natural Ruler, Treaty King of the Efik and the Obong of Calabar, and him pipo sey dem don stand gidigba for ground to welcome him colleague and friend, His Royal Majesty, Omo N'Oba N'Edo, Uku Akpolokpolo, Ewuare II, Oba of Benint to Calabar on Friday wey be 10th of January 2020.

De tori come follow tuk sey de visit na for de Oba to come tell him friend sey "Thank You o, as you attend my coronation". Dem tuk sey the visit go also give de two natural rulers de chance to take tuk other tins wey concern de royal and ancestral relationship.

De Oba of Benin bin don write letter give de Obong of Calabar sey him wan come visit am and for him visit him go like meet all Edo state children wey live for Calabar and after everytin, before him go on Monday, him for like go greet oga governor of the state.

According to de tori wey we get, de friendship between Calabar pipo and Benin Pipo bin don start since 300 years ago and even sef, dem come tuk sey one Oba of Benin bin don come live for Calabar here until him die. Sey him grave still dey Calabar here.