Kate Henshaw





Our sister, Kate Henshaw don warn all those pipol wey sabi waka dey insult celebrity for social media sey make them no carry come near am at all.

Sister Kate bin sound this warning untop her Twitter handle as she tuk sey anybodi wey try to insult am go collect am as she go block dem one hand.

She tuk sey;
"make I tell una one time, if you wan write anything untop my mata, make u do am wit respect, because me I no be your mate, I go block you one hand if you carry your stubborn head and insult come my conner. I no dey take nonsense".


Dis yarn wey she yarn so don make plenty of her friends don dey wonder wetin happen wey she for para like dat? Some pipol don tell am sey make she just tell dem wetin happen, because dem dey ready to take her mata for head. Others don tell am sey make she calm down, sey social media na free world.


Get this straight, if you are coming on my TL or into my mention, bring your respect along. I am not your mate....You will be blocked.. best believe. Rudeness will not be tolerated.."