Wetin we see dey happen for inside Cross River state so, even as everywhere just dey quiet with de peace wey come full everywhere so, na becos of wetin oyibo dey call "Gentleman Agreement". Na dis kind agreement bring turn by turn for who go lead de state. Oyibo de callam "zoning". If Cross River state must go forward, de pipol of de state must to respect dis zoning.





As e come take be, na so plenty politics pipol don come believe sey na dis zoning make wey ogar Ayade, wey be governor of Cross River state take win im election wit plenty plenty votes to come be governor for de second time.


Now, wey every senatorial district for we state don dey chock eye for office of number one man for state house of assembly (Speaker), na im me come think sey e for better make I cucuma position things well make everybody sabi dey true mata for de gist.

Dis zoning wey e be wey na PDP bring come so, e don come be sey, office of speaker suppose waka jeje go meet pipo for central wey be old Obubra and Old Ikom since ogar Governor sef him from North and de person wey de follow am for back him from South, then the number one man for Law making suppose come from Central.( abeg make nobodi struggle am with them).

Na only longa throat and disrespect for the zoning arrangement go make anybodi wey no from dis zone to comot sey him wan be chairman for de law making house. Abeg make I make am clear una well well sey de chairman seat for de law house, na central get am, so make nobdi smell dey at all at all.



For central we get old Obubra we be- Yakurr, Abi, and Obubu and we come get Old Ikom wey be- Boki, Stung and Ikom.


Now make we look inside, see wetin every of dis Local government dem get for this current government.


Old Ikom
First, we sabi sey d office wey big pass for law making mata na dat one wey dem de call senator, and Etung for inside old Ikom don carry dat one, also Boki still for inside Old Ikom been don kidnap office of the Secretary to the  State Government, (SSG) tey tey. 

Make we also no forget sey all the three local governments for Old Ikom dem get two two commissioner each, while the other three local governments for old Obubra  come get only one commissioner for inside Obubra Local governments Area.


Old Obubra
Make we enta Old Obubra now, Remember sey Yakuur LGA been don carry  Speaker of CRS House of Assembly before for that time wey Rt. Hon. Bassey Eko Ewa bin be speaker.



Even as we dey so now, na Abi LGA dey hold dis position through their pikin Rt. Hon John Gaul Lebo. And dis same Abi get pass two commissioners wey get power well well.


So, as dey mata come be so, we don carry our eye see sey every local government don get one thing or the other, except Obubra wey dey empty hand like sey dem no get anybody. So me I for tuk sey make dem carry office of the chairman for Law House carry dash Obubra wey never get anything before. Even as dem go consider who get qualification pass. 



I dey also beg all de pipol wey dey for our law house make dem waka together do wetin dem know sey na de right thing to do. Na so God go bless dem too.