De governor of Cross River State, and winner of de election wey just finish so, Sen. Prof. Ben Ayade don beg all de pipol wey bin follow struggle de goverborship chair wit am sey make dem come work with am as him alone no get all de sense to carry we state go forward.


Ayade wey bin tuk dis tin on Thursday for Calabar, wen him bin meet wit pipo wey mata for de state. Him tell de stakeholders sey their ideas go help am push de state go forward.


De governor bin tuk sey; "For dis my new government so, Cross River go start to chuck im eye for tins wey go bring money and prosperity give de common man for street.

I for like make everybody wey from this state, especially those pipol wey bin follow me struggle for this chair to sabi sey, me I dey ready to work with everybody

" I no fit wait to see dem come together make all of us put our sense together. Some of dem get beta sense wey fit build we state, if we all come together beta tins go happen for we state and our pipol go happy".


Our papa for de state, ogar Ayade bin come tuk sey, him happy well well sey de election wey just finish so bin dey very peaceful

He expressed delight over the credibility of the election across the state, describing the process as peaceful, as him bin come swear sey dis him second term go beta well well for country mam.