Hon. Bassey Ekpo as him bin dey do campaign for Akpabuyo 


As oga kpatakpata dem for election matta for we country, INEC don release de election timetable for de by-election for Ogoja/Yala Federal Constituency and Akpabuyo state Constituency, de person wey All Progressives Congress, choose to represent dem for de election, Hon. Bassey Ekpo don tok sey him dey ready and him stand gidigba for ground to go represent Akpabuyo pipol for de House of Assembly for Cross River State.


Ekpo bin talk dis wan wen him party bin carri de election campaign go three council wards for Akpabuyo. Na so Ekpo come call on Akpabuyo pipo sey make dem no make d mistake go sell their votes for election day o. Him sey na because of de suffer wey dem de suffer na it make him wan go bring good tins wey democracy suppose give dem.


For de time wey him bin dey tok too de state chairmo of d party, wey be Barr. Alphonsus Eba, him tell de pipo sey make dem follow show governor Ayade love for de plenti plenti things wey him don do give them even as govenor make sure sey plenty of their children de work with government.

APC party chairmo, wey bin dey represented by him seke seke, Mr. Mensah come beg de pipol sey make them no allow any person come deceive them for de election o.






Also other pipo wey chuck mouth for de mata na commissioner for, Mrs. Rosemary Archibong, APC chapter chairman for Akpabuyo, Chairman of Council for Akpabuyo, de campaign Director General and plenty other senior men wey show for de event. All of them tok to Akpabuyo pipo sey make dem vote for APC when dem go polling unit.