As de world dey celebrate young pipo, some correct organization don gum bodi to also help some young pipol make dem do better work for Palm oil business. 


The group wey call dem self, Youth Training Hub Africa, and Solidaridad bin hold program for Calabar to take show their support for 48 young pipol wey de do Palm oil farm work. 


Madam Nozi Izuora Songu wey tuk wit our tori person, tuk sey, her organization, Youth Training Hub Africa de work wit young pipol to support dem, train dem and also link dem wit big company or organization wey go fit sponsor dem. 


She sey government suppose give young pipol de chance to also give idea on how dem fit take help young pipol. 


Na so she come call on young pipol for naija sey make dem no give up but continue to dey try their luck dey pursue their dream sey one day e go betta. 


One of dey pipol wey benefit for de program tuk sey him happy well well as now him palm oil farm dey produce plenty plenty pass before and him no dey spend plenty money as him bin dey spend before. 


See pictures of de event for here: