Youths for Ekorinim community don beg the governor of Cross River State, ogar Ben Ayade, the Commissioner of Police, Assistant Inspector General of Police and de Ogar kpatapkata of Police wey be IGP sey make dem come help dem o.

De youths dem tok sey e get one Chief wey wan sell their land finish, sey this Chief dey use police officers de wahala the whole community. Dem tok sey Chief Ita Nyong don cause plenty kata kata for their community and them don tire for the man mata. 

As dey youth bin de talk to pressmen for Calabar dem tok sey de wan wey happen recently na de one wey de police officers wey Chief Ita Nyong de carry waka everywhere come go shoot their deputy Youth Leader on Saturday. 

De Youth dem don tok sey if Government no want make big wahala dey for Ekorinim, make dem make sure say de police officers wey shoot their brother and Chief Ita Nyong face de law. Dem tok sey dem want justice for de matta.



According to Mr. Augustine Nyong as him bin de tok with pressmen, him tok sey de mata with Chief Ita Nyong and de community na tete matta wey don reach 10 years since 2013. Sey Chief Ita don cause plenty wahala for the community. Him say as e be now, de Chief get like 4 different matta for court against the community, youths and other pipol.

Him sey, everytime wey de mata wan go forward Chief Ita Nyong go bribe police naso dem go kill de mata. The youths come tok sey Chief Ita don sell all their ancestral land finish, use de money build hotel, and other factories.

De youths dem sey dem want justice.


But when our tori person contact Chief Ita Nyong, him tok sey na lie wey de youths dem de lie sey nothing like that bin happen. 


As we come contact de Police Public Relations Officer, madam Irene Ugbe, she tok sey police no de aware of de matta, but when another tori person call the woman, she tell am sey de matta de with Zone 6, as de tori person call zone 6 dem tok sey dem no dey aware of the matta. Naso we come ask am sey why police de try hide de matta? Abi na becos sey de matta involve police officers? De police man come vex, begin to de shout for phone, de quarrel plenty. 


As we de follow de matta de go, naso we come hear sey the state Commissioner of Police don get meeting with both de Chief and de community Youths and dem come detain de two police officers and Chief Nyong. But as we come hear for Wednesday night, de don grant de two officers and Chief Nyong bail. 

De question now be say, as de matter come dey like dis how justice fit commot from dis matta? 

So naso like play, like play de two police officers go, go free without paying for their crime wey de shoot innocent citizen wey no be criminal. Na who go pay for him medications wey we hear sey don de reach #400,000? 

Abeg make una follow chuck mouth for this matta o