De Oga kpatakpata of Ben Akak Foundation, wey bi Oga Ben Akak don tok sey him choose to do business so dat him go fit help pipo wey no fit gada tins for dem selves.

Oga Akak bin come tok dis one when him open him new business wey dem de call Bengies Bakery. Him tok sey Bengies Bakery na one place wey dem dey produce special bread wey u no go ever see anywhere 

As Engr. Akak de tok with tori pipo, him come tell dem sey de Governor of Cross River State, oga Ben  Ayade don make to do business for Cross River State don dey very easy, especially as him say make some special pipol no pay tax again. Oga Akak sey dat tin sweet him belle well well, say tax na wetin every business person suppose we happy to pay as de money de help maintain de state.

Him come tok sey him business de assist government give pipol job as gomment no get power to give everybody job. 

Madam Elizabeth Ayade wey be Dr. Frank Ayade wife been follow tok sey heart sweet am well well as she don take her eyes see as de Bakery start work. Naso she come tank oga Akak as him dey always try to help gomment increase de live of pupil with all dey good tins wey him dey always do give pipol. 

Engr. Akak wife, wey be Joslyne Akak tok sey she done dey do business for 10 years now and she don gada plenty experience wey go help dem for did new business especially her own JossyClean and event management business.

De chairman of PDP for Cross River State, Ntufam Inok Edim, tok sey Ben Akak don follow contribute for dey GDP of de state sey make God bless am for all de good works wey him dey do.


De programe bin get plenty pipol as special guest. Like Pastor Emmanuel Elias, Evang Theodore and Ephraim Effiong and plenti plenti big big people