E get one man wey dem dey call Dr. Elocate, him bin dey among dos pipo wey de make laws for inside Cross River State House of Assembly, for Calabar.



Na so him just dey der o, on the 3rd of July 2018, sometin just enter am for head, him sey him no wan be PDP member again. As e come be so, Naso im pipo for de same house of Assembly come read law give am, tell am sey since na PDP carry am come de Assembly house, to come make law, and after him don enjoy de place small, him wan come pin Okoro as pesin wey get sense, tuk sey him wan go join APC.

"...in dat case you no go stay for dis house again Ngwanu, make you come dey go back ya village". Na so dey house come drive comot go back village, him no come be lawmaker again.
Elucate, wen him bin go join APC 


After some years wey de tin don clear am for eyes, come join wit hunger wey follow am, my guy man don gather sense, him don return back to PDP today wey be Sunday, 15th December. As prodigal son for Bible, na so Dr. Elocate take come back house this morning for Iyamoyong ward, inside Obubra local government area.

Tori tok sey na Rt. Hon. Mike Etaba wey dey for Federal House for Abuja, na him welcome am come back PDP.


Some pipo wey sabi tok well well say as dem see de matta so, e bi like sey Elocate wan dey eye Obubra local government council seat as chairman, na im make am return come back PDP.

Anyhow sha, countri pipo as de tori dey come Naso we go yarn una, but for today Naso we hear am reach.

See all de plenty plenty picture as Hon. Elucate Ekom take come back PDP :