Comrade Ita, taking the oath of Office
As NAOS WW President





 History don happen again as Comrade Emmanuel Ita become Worldwide president of Odukpani students.

Dis one bin happen yesterday wen de spirit head of National Association of Odukpani Students Worldwide bin swear de new executive members wey dem bin elect put office. De tin bin happen inside Cross River University of Technology wey dem de call CRUTECH.


As she bin come tuk during de time wey she wan handover, comrade Valentino Nadarake, former president of de association, tuk say she tank God well well and everybody wey help am carry de association go reach that Very day.

She come, advise ogar Emmanuel wey take over from from am, sey make him try continue from where she atop.

She bin tuk sey she sabi sey plenty hindrance dey ground but make him focus do him work, make no mind anybody.




As him come de tuk, to show sey him don accept everything, Conrade Emmanuel Ita, tuk sey him tank everybodi wey make sure say him win de election and also come make sure say de swearing hold.

Him tuk sey him no go disappoint anybody but go try im best to carry association go reach de next level.


De occasion wey carry plenty big big pipo enter inside CRUTECH, come end as all de executive collect deir certificate of office

Spirit Head of NAOS WWW administering
 Oath of office on the executives

Mr. Ita receiving his Certificate of Office