Tori wey reach us tok sey Department of State Services wey dem de call DSS don catch some girls wey de do ashawo work for Peace Garden Hotel and Papsi Place wey dey for Mutala Muhamed road for Calabar, Cross River state.


De ogar kpata kpata for DSS wey be ogar
 Ilupeju Adebayo, tuk sey dem catch the girls as all of them dey naked for de hotel. Some of de girls na small children of 13, 15, 19 years old wey some wicked group of men bring from other places come for Calabar make them come do ashawo work give dem.

Dey DSS ogar tuk sey im men follow arrest about 16 men for dey de hotel around 2:15 o'clock for morning. 


One of de girls wey dem bin arrest tuk sey na her friend bin carry from Rivers state come Calabar sey na sales girl work she go come do. But as dem come reach, she carry am go meet one Aunty Favour for one hotel for Atamunu, for Calabar South make she go do 
ashawo work naso she come run, but them follow am come beat am with cult boys, since then she come continue. De girl sey she no happy at all as she dey do de kind work wey she no plan for.



Another person wey dem arrest one, Edem John wey be de owner of Papsi place, tuk sey him no do anything bad O sey na just hustle wey him dey hustle to take care of him family, sey de girls dey come use him hotel for ashawo work dey pay am, but him don dey warn de small small ones make dem no come dey again but dem no dey hear.


For now, police tuk sey dem don call de government pipo wey dey handle did kind matter, wey bi National Agency for the Prohibition of Trafficking in Persons as dey wan investigate de matter, rest everybody wey get hand for de matter den carry all of dem go court.