Big yawa don gas for Abuja, as one Federal Court don gree sey make police arrest, Senate president, Bokula Saraki, Sen. Dino Melaye, Sen. Ben Bruse and other plenty pipol.

For de time wen de judge for de mata being dey read him judgement, as Saraki and him friends bin don go tell court sey Nigerian police don disturb dier fundamental Human Right. Sey police, put dem fear for body, insult and harrass and embarrass dem.


But on Thursday, as Justice Okon Abang bin dey give him judgement, him tuk sey make sen. Saraki and him friends go accept de police invitation first wey police bin don invite dem for 5 October 2018, as e take concern de demonstration wey PDP members  bin do.



"Me I believe sey, de invitation wey de Police bin invite dem Saraki, na better tin dem do, so e go better too make Saraki and him friends no fail to honor de invitation.

If dem go see police for deir station and de police treat dem anyhow, na from der we go take start court fight for Fundamental human right."


Him tuk sey de court no go fit stop de police from doing deir duty especially sey dem no do wrong to invite dem com station.