Country pipol, anoda one don happen o!



One 17 year old girl wey dem dey call Cynthia Mubanga, from Kalulushi, for Zambia, been confess give police set she raped her best friend broda wey be just 4years old.


Cynthia tuk sey to sleep wit man bin don dey hungry am since d day wey her best friend dey always tellam how her boyfriend dey always do de tin wit am.
She cum tuk set na so de tin come dey hungry am too, since she no get boy friend, she come decide to do de tin with her friend junior broda.


Cynthia bin dey tuk did tori for her parent front, and de four year old boy parent bin follow dey wen she dey give dis confession for police station. She come tuk sey she dey very sori for wetin she do.

According to her, "I bin always dey feel horny every time becos of de tori wey my friend Katherine dey always yarn me for school. And since I no get bobo wey go do dey tin with me na so I come decide to sleep with Katherine younger brother, I dey very sorry, abeg make una forgive me".


De Doctor wey come look Cynthia bodi, tuk sey she still be virgin as de small boy bin no fit enter am well to disvirgin am.



Country pipol, na so de tori bin happen o!


Tell us wetin u tink for dis tin wey just happen so.