De Department of State Services, wey dem dey call DSS, for we Cross River State don tuk sey their officer, Mr. Eyo Bassey Eyo no follow for de kidnapping case wey make am go sleep for police cell.



According by de tori wey de Oga Kpata Kpata for DSS for Cross River State, Mr. Adebayo Ilupeju bin sign give news pipol,  him tuk sey dem don hear as pipol don dey carry small small gossip dey waka for town sey police arrest DSS officer wey go kidnapp person. Him sey dat tori no bi true at all.


De DSS ogar come tuk sey, dat kind tuk na wetin oyibo man dey call Misrepresentation of de real tin wey happen. De ogar com explain tuk sey de true tin wey happen be sey one of their staff bin follow him friends go somewhere and him no sabi sey de person wey dem to meet na person wey bin owe dis im friend money as e take concern admission matta.


Im sey as dem come reach de house, de person wey dem go to see turn back call police sey some pipol come to kidnapp am, na so police waka come, come arrest all of dem,  dem no even gree sef make de DSS staff explain imself, naso  dem carry all of dem go put for cell as criminal.


De DSS ogar, tuk sey, e de very important make dem explain de whole mata like dis so dat country man go sabi de true tin wey happen no be de gossip wey pipol de spread around. Im come tuk sey as de mata come be like dis so, dem for deir command dem go make sure sey dat deir officer wey fall hand so, sey dem go discipline nam well well, because him don disgrace im work as im go do work wey dem no send am.



De tori wey Oga Adebayo Ilupeju na im bi dis:




PRESS RELEASE

The attention of the Cross River State Command of  Department of State Services (DSS) has been drawn to the alleged arrest of one of its personnel, Eyo Bassey EYO and his subsequent parade by the Anti-Cultism and Kidnapping Squad of the Nigeria Police in Calabar, Cross River State over suspected kidnap.

The Command wishes to state that this is a misrepresentation of what happened. The fact is that EYO had accompanied three (3) of his friends namely Eyo EDET, Sylvia JAMES and Jason UDO to assist them recover a debt from Robert BASSEY.

Investigation has revealed that BASSEY had fleeced the trio of EDET, JAMES and UDO of a certain sum of money with a promise to help them secure admission at the University of Calabar.

But  when BASSEY could not fulfil his obligation, they demanded a refund of the money which he had defaulted severally.
The story was brought to the attention of EYO who advised that the matter be reported to the Police. His advice however fell on deaf ears and unknown to him, his friends took him along to the home of BASSEY who connived with his brothers and invited the Police claiming that they were being kidnapped.

On arrival, the Police apprehended the alleged kidnappers and EYO who was in the company of the trio.  Meanwhile,  approriate disciplinary action will be taken against Eyo for engaging in debt recovery. This is termed an illegal operation as it runs contrary to the Service’s rules for conduct of its personnel.

It became imperative that  this explanation is made in order to put things in their right perspective.  The Service maintains robust relationship with other sister agencies and will further assist the police in its investigations.



State Director of Security
Department of State Services,
Cross River State Command
Calabar
23rd March, 2019.