Dr. Alex Egbona, wet win election to go represent Abi/Yakurr constituency for National Assembly tuk sey even as e be sey him and Sen. Liyel Imoke no dey de same party, but Imoke still be im papa for Politics.



Chief Egbona bin tuk dis one wen im bin dey ansa questions from New Telegraph. Dem bin ask am sey pipol dey tuk sey im former ogar Sen. Imoke bin fight am well well for dis election wey just finish so, how im come still take win de election?


Dey chief wey pipol tuk sey him get sense well well, come tell de newspaper sey make dem no tuk sey him former oga fight am,  instead make dem sey him former ogar bin work for him party to win.

Na so him come sey him believe sey every true party man ho want make him party win election and na de same tin wey Sen. Liyel Imoke bin do for de election wey just finish so.

According to am, "Tuk dey easy to tuk, anybody fit tuk anything wey dem like, but wetin me I sabi be sey Sen. Liyel Imoke, wey be former ogar Kpata Kpata for Cross River  State, my ogar before before and my papa for  Politics na person wey I get plenty respect for'.


"My story for politics no go complete if dem no mention Sen. Liyel Imoke join for my mata, see make I tell u, no mata how pikin big reach, him papa still be him papa and any pikin wey dey carry de blessing of Papa for play no sabi wetin  him dey do".

"To anywhere Imoke still be my papa, our relationship pass politics own. Na it make I go respect am till tomorrow".  


Before dis time, him bin don tuk sey, him no go fit judge anybody work, especially those pipol wey  bin don sidon for de sit wey him wan go sidon for National Assembly, becos e no go add anything to de life of de pipol wey him wan represent. But him sabi sey anybody wey bin sidon for de seat before am bin try him best. 


As dem ask how him bin feel wen him hear sey na him win de election? Him tuk sey becos him bin don do de right campaign for every where for de two local government area, so as INEC call him name as winner, na so him kneel down carry two hands for up thank Baba God for Victory.