If we wan follow tori wey we hear, we fit tuk sey at least five pipol fit don die for cult fight wey happen around Urua Ekpa community for Uyo, Akwa Ibom State.



De tori tuk sey de trouble bin start wen members of one cult group wey dem call Viking confraternity struggle for fight since Tuesday night till go reach Wednesday morning with another group wey dem call the Iceland group.



We never fit sabi wetin cos dey fight but person tuk sey e fit be becos of woman pikin.

Person wey sey him see as dey whole tin bin dey happen tell tori pipol sey around 9 o'clock for night, "As I dey return from market, I hear as dem shoot gun, I bin first think sey na motor cycle tire bust. But after sometimes, I come hear another one, na der I come know sey something don Happen."

E no too tey na im I see as pipol de run yakata, by dis time dey gun shut don come plenty everywhere, since uesteday, dis we area no de safe at all, dem don kill about three person with one of my neighbours



Anoda, person wey sey him follow see wetin bin happen, tuk sey as him dey waka to go open him barbing shop, na so him take see everything.

Him sey; " Big trouble dey we area o, some boys bin com trouble us here yesterday, as I dey tell u now, I fit tuk say about two person for our street don die for this fight wey happen since last night.

"I bin dey prepare to go work for my barbing saloon dis morning wen I see some boys as dem dey pursue my neighbour until dem go catch am for de other side of our street, na so dem come kill am like fawol".



As we dey tuk so, de person wey dey tuk unbehalf of Police for Akwa Ibom state, MacDon Ogbeche don confirm am sey true true dem bin don hear am sey yawa dey happen for Urua Ekpa side, as dem too come put ear for ground, dem come sabi sey na two cult group dey fight.

So de Ogar kpata kpata for police for de state don order police men go de place. For now dem don arrest two person wey dem feel sey get hands for de yawa.