Oga Asuquo Ekpenyong Jr. wey be Commissioner for Finance for Cross River State don tok sey him no go follow join de race for 2023 to be governor of Cross River State.

Him bin tok dis one yesterday as him bin dey meet wit Press pipo. Ekpenyong Jr. tok sey make pipo leave am make him do de work wey dey him hand. Him sey if him finish for him commissioner work him go jejely return to him business sey wahala too much for politics. 


All dis one bin start when dem accuse am sey him don follow politics sotey Cross River don lost plenty moni from world bank. Naso de young commissioner come vex for dat question come, dey para tok sey, "Abeg make una stop all dis small children yan, Make everybody hear am well now, I no wan be governor for 2023. All I want na to do de work wey I de do now, den if I finish, I go face my business." 


But before now tori bin don plenty for ground sey oga Ayade de prepare young Ekpenyong to take over from am, and if  e happen like dat, Ekpenyong go be de youngest Governor for de state. But now wey we don come hear from de horses mouth then de matter don finish be dat. Except sey we no fit trust politicians. Becos we no go surprise sey him go swallow back him words of time reach.