Police wey dey for Eket Divisional headquarters don arrest plenti pastors wey fit reach 10 becos dem hold church service today for dier church. 


Dis one happen becos, Governor Udom Emmanuel bin don give order on Thursday tok say make persin no commot again becos de pipo wey dey in charge of disease for Naija, wey dem de call National Centre for Disease Control (NCDC) bin sey dem don see 5 pipo wey get coronavirus for Akwa Ibom State. 




Naso de governor sharpenly come give order say make everybodi lockdown including churches and mosque. 

But tori pipo gada sey de Ogar kpatakpata for Deeper Life Bible Church for Eket and him friend for United African Evangelical Church and some others wey we no fit know their names as we bin dey write dis tori, been come strong head still disobey government order go hold church service. 


Naso police go gbab all of dem o. As we dey yan now, dem dey cell dey cool down dey.