Nigeria don confam11 new cases of #COVID19.


Di Nigeria centre for disease control, NCDC, tok am for dia twitter page at 11.55pm on friday, 27 March.

For dis new cases wey test positive, 8 dey Lagos, 2 for Enugu & 1 for Edo State.

As e be now, na 81 confamed cases of #COVID19 dey di kontri; three don recover and one pesin don die.