Pipo wey de do business with wood for forest wey call themselves  Timber Dealers Association don tok sey now dem don believe sey governor Ben Ayade don dey ready to do d correct tin as e take concern forest matta.

Dem bin tok dis one wen, Mr. Odey Oyama wey be Oga kpatakpata for Anti-deforestation Taskforce bin go meet with dem. Na so dem open mouth come de praise oga Governor for sey him see road well well as him go appoint Oyama to over see logging matta for forest. Dem tok sey Oyama na better person wey no de take bribe, e no de do wurowuro business at all. 

Their president for d Timber Dealers, Mr. Asuquo Ita come tok sey heart sweet dem well well as Oyama come meet with dem, sey na de first time wey dis kind tin de happen and dem too don commit demselve to make sure sey Oyama succeed for d job and government too follow make money through revenue wey go dey pay. 


All of dem wey tok for de meeting tok sey dem dey ready to join hands with Odey Oyama to fight bad pipo commot for de logging business, becos dis pipo de spoil market give dem.


Also Oyama come tell dem sey make dem call police to arrest any fake logger or person wey tok sey him be government person.

Before de meeting end, dem bin gree sey dem go start wetin dem call DECLARATION, so dat everybodi fit go claim him wood wey de forest.