As dis year Carnival de come close and as de state government come dey do de last final test tests to take see how successful dem preparation don reach so dem fit do any last minute preparation before de carnival, naso Cross River pipo come dey chuck their mouth dey ask governor Ben Ayade some serious questions.


One of de questions wey dem ask come be de matter wey concern their brother Agba Jalingo. Naso dem come de ask oga govor sey how him wan take celebrate carnival wey him call Humanity, but him still put a fellow Cross Riverian for prison, just becos him ask am question wey him no fit answer.


Na so Cross River pipo come tuk sey how oga governor go sey him dey celebrate humanity when him no get human heart.


Remember sey Agba jalingo and Joseph Odok still dey prison and the judge wey dey handle their case dey delay case purposefully. 











De pipo wey put mouth for dis tok na:


 Ud Ofem wey tok sey
#AgbaIsInnocent why this callousness for Christ sakes? Let this witchhunting end for the sake of "HUMANITY" that you profess and will dance to in this year's carnival. Ooh! God! This is sad, this is heartbreaking 😭😭😭

Obudu people, elders and elites, shame on you all, for the sakes of your stomachs, you sit back, arms folded, lips sealed and watch your kinsman languish in prison for no crime committed without acting. Kpash!!!



Oga Solomon 
come follow tok him own sey: 
"Inhumanity is when Carnival Calabar 2019 is "Humanity" while Agba Jalingo is inhumanly languishing in unjustifiable  detention". 

 Ud Ofem
Humanity😎😎?
Dancing on potholes😕😒?
Agba Jalingo😞😞?
Shiorrr...😙😙

Nyok Efio-Ita follow put mouth for de matta as him tok sey: 
"Odok & Jalingo are still in detention while we celebrate  the #humanity themed Carnival Calabar in the last Dry Run exercise today. Humanity in deed!"