By Inyali Peter

Right from de time wey oga prof Zana Apkagu bin come take over as oga kpata kpata of the University of Calabar, na so beta bata tins just dey happen turn by turn for de school.

De oga wey sabi bodi well well don do plenty tins wey nobodi don do since dey university start and before anybodi go fit do some of de tins wey him do, e go take time well well.


Prof Akpagu na de first Ogar kpata kpata of de university wey graduate for de same university. Im com also be number 10th Oga kpata kpata of de university and dis number 10 come make sense well well.


According to history, oga Akpagu, na de first person from de northern side of we state to grow from commissioner of Education to Vice Chancellor of UNICAL.


De sabi bodi Vice Chancellor don bring plenty law and policies wey don well correct plenty tins wey bin de go wrong for de school. Becos of dis, de school don dey shine for wey oda big schools de follow shine.


Apart from laws, Akpagu don put tins for ground wey pipol don follow carri eye see. Pipol wey de do statistics dem tuk sey all de project wey Akpagu don do fit dey equal to de number of months wey him don be VC for de school. Na dem com tuk sey since him com UNICAL, im don start about 30 different project wey plenty plenty don finish reach dey end, na just small like 20% of de projects still de ground wey dem go soon finish. 

Dis man wey dem de call Akpagu, na very correct man. Im correctness no stop just to dey put laws and build tins for inside UNICAL alone o, him carry im correctness chuk eye for wetin student dey study for school, na so im don com increase de number of degree wey children fit com learn for UNICAL, im don add four new faculties and plenty plenty degree wey oyibo man dey call Programmes and department.

De faculty wey Akpagu add na Pharmacy, Engineering, Environmental science and Dentistry.

Den de  many programmes wey im add na, Music, Mass Communication and Digital Media, Fine and Applied Arts, Tourism and Hospitality, Dentistry, Pharmacy, Civil, Electrical, Chemical and Mechanical Engineering, Architecture, Estate Management and Evaluation, Surveying and Geo-informatics, Urban and Regional Planning, Physiotherapy, Food Science and Technology, Criminology and Anti-Corruption Studies.

No VC for UNICAL don fit do dis kind expansion for bokuro work, (oyibo man call am curricula expansion)