Rt.Hon. Daniel Asuquo





Picture evidence don show sey, one National Assembly member, Rt. Hon. Daniel Asuquo, wey dey represent Akampka/Biased Federal constituency for House of Representative as im dey disobey we country laws.


For de picture wey reach As e de Happen office, na so we see as Rt. Hon. Daniel Asuquo wey dem dey call Dansuki as him dey spray raw Naira note for persin bodies.


According to de informate wey reach us we hear sey de tin bin happen for Ikom Local Government Area of Cross River State as the NASS member bin attend burial of former local government chairman.


De musician wey dey sing for live band bin com sing one sweet song de praise Dansuki, na so oga Dansuki wey tuk sey im wan be Governor come forget im bodi waka go spray de musician money.


Remember sey Federal government through Central Bank of Nigeria CBN bin don warn country pipol sey make dem no dey spray money again, if not dem go go prison.

See as Oga Dansuki de disobey we country law

See as oga Dansuki dey spray money for pubic



See de story here as Premium times bin report am last year.

"The CBN spokesman, Isaac Okorafor, who said mobile courts would be deployed nationwide to enforce the law, confirmed the police and officials of the Federal Ministry of Justice would be involved in the monitoring and enforcement of the law.


“If a celebrant is dancing and you spray him/her, you may go to jail from the party venue, because the law enforcement agents will be there, waiting to arrest you,” Mr Okorafor said in a statement published by the News Agency of Nigeria (NAN).


“It is the duty of the law enforcement agencies to catch offenders and take them to court. Our (CBN) collaboration with the police will intensify as we move to implement the mobile court for offenders,” he said.




Wetin country man dey ask now na, as e come be sey na lawmaker de break law who go repair de law or who go fit arrest am?

Abi him don big pass de law?