Dis na de question wey dey plenti government worker mouth o.

Plenti pipol don dey complain seriously as month don finish and oga governor never give order make dem pay salaries.


Everybody sabi sey oga Ayade dey always pay salaries before month end some times na from 22 day of the month wey him dey pay other times na first week of de month even before dem work for de money sef.

Also Read: Come, make we work together, Ayade beg opponent

As e com b so,  countri pipol don de tuk sey na becos oga governor carry money buy election na it make him no get money pay salaries.

Odas tuk sey na de new pattern wey him wan de show now, sey before him bin de  quick pay salaries so dat dem go vote am for second term.